728 x 90



Nigeria politicians wey don dey run for political office since 2003

img

Di coming 2027 general elections for Nigeria don bring to mind some ogbonge politicians wey don try several times to win elective positions but dem no fit, either say dem no get wetin dem want or dem no even get at all.

Nigeria start dis current cycle of democratic system of governance for 1999, afta di kontri military bin dey in charge for many years and power bin dey change hands through coup d'états.

Since dat ogbonge election of 1999 wey bring in Olusegun Obasanjo as president, some politicians don dey try to get diasef into particular positions, but e neva sup for dem, while for some odas, no be di particular position wey dem dey go for dem get, so dem continue to search.

Dis article torchlight some of dem:

Atiku Abubakar

Even though Alhaji Abubakar na di vice President of Nigeria unda President Obasanjo, history don show say dat number two position for di kontri no be really im main ambition, but na to be di number one.

Tori be say oga Atiku folo drag di presidential primary election of di Social Democratic Party (SDP) wey produce Alhaji Moshood Abiola for di June 12, 1993 election.

Even though dat election hold and di general consesus be say na Abiola win am, di military govment of Ibrahim Babangida dat time cancel di election and remain power.

So, wen di military wan handover power, Atiku bin contest and win di govnorship ticket of Adamawa State unda di Peoples Democratic Party, but Obasanjo later tap am to be im running mate and na so e take bicom VP afta dem win.

Wen Obasanjo tenure end for 2007, Atiku try to get di PDP presidential ticket for di 2007 election, but e lose to di late President Musa Yar'Adua. And since dat time reach now, di former Vice President name dey always dey mentioned for evri election cycle as e dey always wan run for President.

For 2023, e contest unda di PDp and for di 2027 general election, Atiku na di presidential candidate of di African Democratic Congress (ADC).

Great Ovedje Ogboru

Great Ogboru don dey run for di office of di govnor of Delta State since 2003, and e go still contest for di coming 2027 poll.

For 2003, Ogboru run unda di platform of di Alliance for Democracy (AD), in 2007 and 2011, e contest unda di Democratic People's Party (DPP). In 2015, e also contest wit di Labour Party, and by 2019, e join di All Progressives Congress (APC) wia e also contest and lose to Ifeanyi Okowa.

In 2023, oga Ogboru also contest again, dis time unda di All Progressives Grand Alliance (APGA, and e come seventh position.

E dey contest again in 2027 unda di ADC.

Donald Duke

Immediately afta completing im secon tenure as di govnor of Cross River State for south-south Nigeria in 2007, Donald Duke set im target for di number one office of di nation.

E announce im presidential ambition in 2007 on top di PDP, but e later withdraw from di race and endorse Musa Yar'Adua who later win di election.

Again in 2019, oga Duke also contest for di presidential seat unda di platform of di Social Democratic Party (SDP), but e lose.

For di 2027 elections, Donald Duke na di presidential candidate of di Peoples Redemption Party (PRP).

Adamu Maina Waziri

Adamu Waziri don dey contest since 2003 to bicom govnor of Yobe State, but e never work for am.

For 2003 and 2007, Waziri contest unda di PDP but e lose both times to di candidates of di All Nigeria Peoples Party (ANPP).

In 2011, E also try to be govnorship candidate but e lose di PDP primary to Usman Albishir. Den in 2015 e manage to win di PDP ticket but lose di main gonorship election to Gaidam Ibrahim of di APC.

For di general elections of 2019, Waziri step down to run for a senate seat, and even though one faction of di PDP declare am winner for di primaries, Inec no recognise am as di authentic candidate.

For dis coming 2027 elections, Waziri wey don be Minister two times, dey also contest for di House of Representatives unda di ADC.